Demsay dem catch one Naija man for Malay Aka Malaysia with
plennntyyyy Igbo,Gbana,Drugs wey e hide inside ceramic horse dem.
Na on Thursday Olopa of Malaysia
dem arrest one Nigerian man wey hide drugs in 7 horse skulputure.
The 28 year old man enter
this gbege wen police come plug am commot for him house around 3pm for one
Taman Prima Tropika,Seri Kembangan for Malay there.
The director by name
Bukit Aman, Comm Datuk Seri Mohd Mokhtar Mohd Shariff talk say the
naija guy carry reach 12.1kg wey the man package inside the horse dolly dem.
Demtoksay na from china
dem carry the many many drugs dem come from, and the Naija guy get correct
passport wey him don dey use for this business tey tey since 2014
The Olopa demsay this our guy dey with one group
wey don dey move tinz enter Malay and many other Western countries dem.
Demsay dem dey use water
filters, women handbags, ink cartridges and portable air conditioners take
transfer this tinz O! Say dem go hold the Naija guy for 14days to take question
am with dem laws under Section 39B of the Dangerous Drugs Act 1952.
Source: New Straits
Times
No comments:
Post a Comment