As you say na you get mouth pass
Una welcom to Demsayblog
Demsay get better hot,ogbonge News,Lifestyle,Sports and many many tori dem.
Sunday, 15 May 2016
Demsay
Lil Kesh dey ask why him no dey get Endorsement Deal…Hmmmm!
Lilkesh Aka Skiborobo skibo Oshey Baddest…Dey ask why him no dey get endorsements like him mate dem even as him don release five Ogbona feli feli tracks for the industry
Demtok say na why him commot Olamide label,sake of say according to am “Who u epp” for endorsement to Olamide.
Mr Kesh, so you think Glo or MTN or Peak or Ribena will give you a deal when ALL you sing about is ghetto stuff?
Wetin dey baffle us be say,Baba Kesh, you feel say MTN,Etisala,Glo or even Gala go give you deal wen all wetin you dey sing about na Nyash,Igbo(Marijuana) and Gbese(Debt)? You sef reason am naa.
Baba Kesh,abeg rebrand yasef,becos even patorankin wey sell kpekere(plantain chips) for streets,stay for AJ city (Ajegunle) don “Packayg” tey tey like say him from Jamo(Jamaica)
Long story short baba “ Pakayg ya Markayt”
Demsay dem catch one Naija man for Malay Aka Malaysia with
plennntyyyy Igbo,Gbana,Drugs wey e hide inside ceramic horse dem.
Na on Thursday Olopa of Malaysia
dem arrest one Nigerian man wey hide drugs in 7 horse skulputure.
The 28 year old man enter
this gbege wen police come plug am commot for him house around 3pm for one
Taman Prima Tropika,Seri Kembangan for Malay there.
The director by name
Bukit Aman, Comm Datuk Seri Mohd Mokhtar Mohd Shariff talk say the
naija guy carry reach 12.1kg wey the man package inside the horse dolly dem.
Demtoksay na from china
dem carry the many many drugs dem come from, and the Naija guy get correct
passport wey him don dey use for this business tey tey since 2014
The Olopa demsay this our guy dey with one group
wey don dey move tinz enter Malay and many other Western countries dem.
Demsay dem dey use water
filters, women handbags, ink cartridges and portable air conditioners take
transfer this tinz O! Say dem go hold the Naija guy for 14days to take question
am with dem laws under Section 39B of the Dangerous Drugs Act 1952.
Source: New Straits
Times
Demsay many many people fit don die for one complex wey collapse
for Abeokuta Ibadan.
Demsay many people fit
don die for one four-story shopping complex wey dem bin still dey build for
Itokun inside Abeokuta,Ogun State early morn morn day before yesterday.
Demsay na Ogun state
Government dey build this shopping complex O! Demtoksay People dem around the
community don join hand dey try help commot people wey dey trap inside the
building…God Help them,as we go dey pray for Dem.
Friday, 13 May 2016
For the people dem wey no believe say Beyonce don go do “Nyash” enlargment surgery….look the foto below well well, Natural “Nyash” no fit get that
kyn shape lie lie!
If na we own “African Nyash" now, no wahala….but
babe, this one na added tinz biko.
CAF Don Nack Naija $5,000 fine say we pack pack people full
stadium like garri for AFCON qualifier
At first
when we see this pishor,we think say na the $5,000 wey dey the caption dey
untop the structure.
But on be so O,na Kaduna State government open doors yakata for everybody to enter
for free during AFCON 2017 Africa Cup of Nations qualifier against Egypt for
Kaduna,wey end 1-1. CAF nack Nigerian Football Federation $5,000 fine
for gross misconduct….Nawa o!
Late legendary singer James Brown pikin don enter another police gbege!
Demsay Vanisha Brown,one of
late legendary singer James Brown pikin who don enter many police gbege many
times over many tinz and even drugs, don enter another one again. We hear say dem say
she don HIGGHHHhhhh! Well well on kpuuf wey dem dey call crystal meth.
For 2014, Vanisha don enter police gbege 24
times!
Na God we pray to say she fit find better
help,because true true….she need am.
Wednesday, 11 May 2016
Dem Say Janet Jackson first husband don burst confession say him and
janet born pikin wey dem give away for adoption.
One
Ogbenge source wey dem call rader online do interview with Janet first husband
by name James DeBarge, weyt him confess say janet born pikin for am.
Him
say one young woman contact am via email about two years ago for the first time
say she ne him and janet pikin. The young woman say she no mind do paternity
test,but him mind no carry the matter, so therefore e never happen.
Oga
james say him dey fear because him never meet the woman face-to-face before.
This
young woman give accurate account of things wey don happen tey tey and wetin
only baba God,himself and janet know alone. She say she no want make anybody
know say she contact am.
Oga
james come talk say na through the emails him him find out say janet allegedly
put their daughter up for adoption.
She
talk say her adoptive mother die,and for her deathbed tell her say she na janet
and james pikin.
James
say him suspect say Jackson get pikin for am and after long search without
luck,him free the matter.
Aunty Janeti!
Subscribe to:
Posts (Atom)