Sunday, 15 May 2016

Demsay Lil Kesh dey ask why him no dey get Endorsement Deal…Hmmmm!




Lilkesh Aka Skiborobo skibo Oshey Baddest…Dey ask why him no dey get endorsements like him mate dem even as him don release five Ogbona feli feli tracks for the industry

Demtok say na why him commot Olamide label,sake of say according to am “Who u epp” for endorsement to Olamide.

Mr Kesh, so you think Glo or MTN or Peak or Ribena will give you a deal when ALL you sing about is ghetto stuff?

Wetin dey baffle us be say,Baba Kesh, you feel say MTN,Etisala,Glo or even Gala go give you deal wen all wetin you dey sing about na Nyash,Igbo(Marijuana) and Gbese(Debt)? You sef reason am naa.

Baba Kesh,abeg rebrand yasef,becos even patorankin wey sell kpekere(plantain chips) for streets,stay for AJ city (Ajegunle) don “Packayg” tey tey like say him from Jamo(Jamaica)
Long story short baba “ Pakayg ya Markayt”

No comments: